Nigerian passport: Nigeria Immigration Service don suspend to receive and process passport - find ou

July 2024 ยท 2 minute read

18 May 2021

Di Nigeria Immigration Service (NIS) don order di suspension of receiving and processing new passport applications inside all passport offices all ova di kontri till June 1st 2021.

Di comptroller General of Immigration Service, Muhammad Babandede announce di suspension wen im dey decorate NIS senior officers wey dem promote.

Oga Babandede use di opportunity to announce di mata.

Why Nigeria Immigration Service suspend Issuance of Passport?

According to di statement by Sunday James wey be di Service Public Relations Officer for Comptroller General of Immigration, di stopping of di passport processing na to clear di existing backlog wey dey ground.

According to di CG of di service, dem wan use di time to allow for clearance of every Passport application wey dem don receive before 17th of May 2021.

E add say dem go send Task Force to Passport offices to clear di backlog.

Na for April federal goment bin announce new passport regime wey go begin on di 1st of June 2021, for delivery period of 6 weeks from di date of submission of applications if all di documents wey applicant submit dey complete.

Wetin be dis new changes?

Some of di things wey di new changes go bring na to create special centres for quick services. Dis special centres go run on public-private partnership basis.

Dem don already start for Abuja and e say 10 more centres go open in coming weeks.

Dem go also fix timeline for every application like collection date. E go be six weeks, comparable to wetin other kontris dey do and dis na to allow enough time to investigate and validate personal information wey applicants supply.

Dem mention say, if anything change dem go communicate to di applicant, one week before collection date.

Applicants no go get basis for further communication wit officers, oda dan to complete dia application process and leave di venue.

Dem go communicate di date for di collection of passports or any challenge to di application to di applicant.

Di immigration service also say dem go publish di list of di backlog of applications wey don ready and di owners neva collect.

Applicants go enta di State commands to collect dem.

Wit dis changes, Oga Aregbesola say im believe say Nigeria Immigration go arrive at a new dawn, he also call for di support of passport officers.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmraeinnp2g5BvaG5sZA%3D%3D